Aston Villa vs Arsenal highlights 2022 : Bukayo Saka goal give Arsenal 1-0 victory over Aston Villa
Bukayo Saka grab di only goal of di game as Arsenal bounce back from Wednesday defeat as dem beat Aston Villa 1-0
Di Gunners now dey four points clear of Manchester United wey dey behind dem for di Premier League table
Saka shot from just outside Villa eighteen beat Martinez to give Arsenal di lead on 30 minutes
Di Englishman goal na im ninth for di season, equal wit Arsenal top scorer Emile Smith Rowe
Villa bin struggle to create much during di game as dem no shoot any shot on target until afta 90 minutes
Arsenal bin control much of di match but di game bin lack big opportunities but di Gunners go be di happiest as dem no get 54 points wit one more game in hand ova dia rivals
46 mins: Arsenal restart di second half as dem lead Aston Villa 1-0. 48 mins: Arsenal win dia third corner kick of di match as Cedric shot hit Young. From di corner, Smith Rowe manage to shoot, Martinez save di shot
51 mins: Arsenal launch anoda attack afta Lacazette pinch di ball from McGinn. Saka find Ordegaard wey shoot but Villa defenders blockk di shot go out for corner. Villa clear di cross from Arsenal corner kick
For More Details About 'Aston Villa vs Arsenal highlights 2022' Click on The Button Given Below.
Thank You